Wetin we know about di shooting for Brown University wey kill students

Police issue video of suspect for Brown University shooting

Wia dis foto come from, Screengrab from police CCTV footage release

Wetin we call dis foto, Police don release limited information about di suspect beyond say e be male wey wear all black.
Read am in 3 mins

Police don arrest one person and dem detain am in connection wit di US shooting for Brown University wey kill two pipo.

Nine oda pipo also wound wen di gunman bin open fire for di university in Providence, Rhode Island, on Saturday.

Police confam on Sunday say dem bin detain one person. Dem don also lift di order wey dem bin put for pipo around di Brown campus and surrounding areas.

Providence Mayor Brett Smiley say seven pipo dey in stable condition, one of dem bin dey critical but stable condition, and dem don discharge one.

Reports say dem bin call police around 16:05 local time to di campus engineering building.

End of years exams bin dey take place wen di shooting happen.

Police bin release limited information about di suspect beyond say e be male wey wear all black.

Police confirm say di suspect use gun but dem no say which type.

Brown University bin earlier say dem dey work to establish "support for our community and families" after di shooting.

Dem say dem bin relocate di students to a secure location, where dem go get access to support services.

"Our first priority na di safety of our community," di university add.

President Donald Trump bin also tok about di shooting.

Speaking to reporters as e return to White House, e describe di shooting as "a terrible tin", and add say: "All we fit do right now na to pray for di victims and for those were dey very badly hurt."

"We go inform you later as to wetin dey happen" e add.

Authorities dey lead students away from campus after shooting for Brown University.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Authorities dey lead students away from campus as manhunt for di gunman dey go on for surrounding neighbourhoods.

'We hide under desks for two hours'

One student wey bin dey work for one lab inside Brown University tok about di moment e receive di text wey alert am to a shooting nearby.

"Three oda students bin dey wit me," Cheung tell local news outlet WJAR. "We decide to turn di light off and hide under our desks."

"I bin dey hope sya nobody dey hurt, I feel like say I dey safe inside di lab," e add.

Di student say e bin dey "under di desks for two hours or so", before armed police arrive to escort dem outside.

Meanwhile, di latets shooting for Providence take di total number of mass shootings for US to 389 for di year 2025.

Dis dey based on figures from di independent analysis website Gun Violence Archive (GVA), wia dem define mass shootings as having four or more victims wey dem kill or injured, not including di attacker.

Di two students for Brown University become di 345th and 346th pipo to lose dia lives inside mass shootings for US dis year, according to GVA.

Dia data show say a further 1,800 don dey injured for di same period.

Pipo hug outside di university after shooting on campus

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Pipo hug outside Nelson Fitness Center after Brown University dey locked down after shooting on campus for Providence, Rhode Island.

Wetin to know about Brown University

Brown University na one of di oldest and most prestigious universities for di US.

Na part of di Ivy League, wey be a group of elite universities for di north-east of di country.

Na 11,000 students dey face serious competition to dey accepted to Brown, wey dey located for Providence, di capital city of Rhode Island.

E dey around 50 miles (80km) from Boston and 180 miles from New York City.

Students bin dey on campus dis weekend for final exams, wey mark di end of di autumn semester.

Officials say di shooting hapun for di Barus & Holley engineering building, wey dey located on di eastern side of di downtown campus.

Di seven-storey building na home to di School of Engineering and di physics department, and get more dan 100 laboratories, dozens of classrooms and three lecture halls.