How one woman wey accuse husband of defiling dia daughters inside viral video end up being di accused

Wia dis foto come from, Getty Images
Police for Enugu State southeast Nigeria don explain why dem arraign for court one 29 years old woman wey bin accuse her husband of defiling dia daughters. Dem be five and three years old.
For statement, police say afta dia investigation, dem confam say di woman lie against di husband wey lead to im initial arrest and detention, dem come go ahead to charge di woman to court on a two count charge of defamation and givng false information.
Di statement from Police say di woman say e hapun between 2024 and 2025 say di man, Mr Ozioma Okonkwo defile im two minors. Police say na di wife of di man report di mata to dem, say di man threaten to kill her if she expose am.
Dis lead to di arrest of di man. Videos wey trend online show wia di man dey shout in surprise for police station on handcuffs say e dey innocent of di accusation. Di tori trend well well as plenti pipo for social media join to condemn di man.
According to di police, during investigation, dem confam say di period di woman say di alleged defilement hapun na di same period wey di woman bin carri her children travel alone from Enugu to dia hometown for Imo state.
Dem also collect handwritten statement from dia seven years old son wey talk say na dia mama coach am and di little girls to lie against dia papa. Dem also collect video evidence to back am up.
Di woman bin later try to withdraw di case and stop police investigation.
Police say afta dem confam say she lie ontop di mata dem arraign am before magistrate court for Enugu on two count charge of defamation and giving false information.
However court don grant am bail and adjourn di case.
Penalty for defamation for Nigeria range from one to two years imprisonment plus fines.
For Nigeria, if dem convict you of lying under oath, you fit spend up to 14 years for prison.










