Police confam arrest of Kanu brother, lawyer, odas for #FreeNnamdiKanu protest

Di Nigeria Police don confam say police arrest Emmanuel Kanu, Aloy Ejimakor and six odas during di free Nnamdi Kanu protest for Abuja, di kontri capital on Monday.
Di police tok-tok pesin, Benjamin Hundeyin during one interview wit Channels TV on Politics Today, tok say once dem conclude dia investigations within 24 hours, all eight of dem go face court for prosecution.
On Monday morning, Omoyele Sowore and oda protesters march to di Nigeria Federal Capital Territory to demand for di release of Nnamdi Kanu, di leader of di Indigenous People of Biafra, Ipob, wey dey face treason and oda charges.
Security agencies take ova major roads and locations for Abuja, Nigeria Federal Capital Territory ova di planned protest.
Tori be say security forces block all di road wey lead to Aso Rock and fire teargas and arrest some protesters wey gada to demand for di release of Nnamdi Kanu.
Oga Benjamin explain say di police bin arrest all eight of dem becos dem contravene one valid court order no be becos dem carry out dia lawful duties as citizens.
"Yes, we arrest im broda and im lawyer too. Becos dem insist on making way to di restricted areas, and no be only just two of dem. We also arrest six odas for dis same reason, so we arrest eight in total," e tok.
"Dem currently dey di state CID, and once we conclude our investigation, just like we bin tok for our statement, dat anybody wey violate dat court order we go arrest am, diligently investigate and prosecute am.
So once we conclude dat, we go do dat tonight, den we go prosecute dem immediately, in less dan 24 hours, dem go face di court."
Benjamin tok say police use tear gas to pursue di protesters becos dem bin dey adamant and unruly despite di warnings dem bin issue on Saturday base on di court order make protesters no gada any wia.
Earlier, security operatives bin fire tear gas for protesters wey dey demand for dem to free Nnamdi Kanu.
Activist Omoyele Sowore lead di march even wit di court order and police warning for di mata.
Security agencies take over major roads and locations for Abuja, Nigeria Federal Capital Territory over di planned protest.
Tori be say joint security forces including Police, Army and odas don mount checkpoints for road especially di road wey lead to Aso Rock.
Already, local report say police already fire teargas as early as 7:00am Nigerian time just as di protesters dey gather.
Protesters start to dey hala, "Free Nnamdi Kanu Now! Na our constitutional right to protest! No dey tear gas us!"
BBC News Pidgin tori pesin capture wia police face am wit tear gas weapon.
E also capture as pipo dey run comot from di area, as some still dey hala say "tear gas no fit stop us".
Di protest bin start near Transcorp Hilton and for oda areas for di kontri capital however, police bin come early and arrange diasef for di main roads to Aso Rock.
Heavy security tanda for Eagle Square, Unity Fountain and di Three Arms Zone sotay some of dis areas pipo bin no fit enta am.
One protester wey call imself Frank tell BBC News Pidgin say, "I dey vex, wetin dey hapun so, no good. Wetin di govment dey do no good.
"We comot to protest peacefully jeje, dem no even allow us protest. Dem throw us tear gas. Dem don pursue us comot from central area. Dem don pursue us comot from Berger, now we dey for Tako, dem dey even throw tear gas for market area. Omo na disgrace. Wetin dey hapun?"

Though, police get court order to restrict di #FreeNnamdiKanu protest to certain locations, di organisers of di protest say dem go still do dia tin.
Despite di judicial order, di organisers vow to stay on dia original plan of peaceful gathering in di Federal Capital Territory and march go Aso Rock Villa.
"Our legal team go challenge any alleged court order di moment dem serve us on Monday. But make dem know say notin go stop dis mass movement," Sowore tok.
E add say "October 20 #FreeNnamdiKanuNow remain sacred. We march peacefully, lawfully, and powerfully".
Meanwhile, di Nigeria Police Force bin don throw warning give any group wey wan protest to comply wit a subsisting court order make dem no carry dia waka go sensitive areas, including Aso Rock Villa, the National Assembly, Force Headquarters, Eagle Square, and Shehu Shagari Way.
Benjamin Hundeyin, tok-tok pesin for di Nigerian police force say di directive follow di order by Justice M. Umar of di Federal High Court, Abuja, for case between di Federal Republic of Nigeria and Omoyele Sowore and odas.
"Di Order restrain di parties and any oda pesin or groups wey dey act under dia instruction from staging protests within and around Aso Rock Villa and its environs," di statement tok.
E say di force go ensure public peace and security, wit warning say offenders wey disobey di order or incite violence go face prosecution.
But Sowore during im tok-tok wit di media for Abuja on Sunday say wetin dey make am vex pass be say, court don release Nnamdi Kanu but di Nigerian govment no wan release am.
"Di detention of Kanu no just dey illegal but na also national disgrace. Di govment dey disobey dia own court order and dey mock di Nigerian constitution (1999 constitution) wey dem subscribe to."
"Di truth, wey dem no want make di world to know, be say di Court of Appeal clear Mr Kanu for 2022, and dem discharge and acquit am, and despite im discharge and acquittal, di DSS neva release am even for a second in disobedience of di Court of Appeal position.
Nnamdi Kanu court case
Nnamdi Kanu mata bin dey bifor Justice Binta Nyako of di Federal High Court Abuja, and na she bin grant Kanu bail on health grounds for 2017, but Kanu run comot from Nigeria afta soldiers bin carry out security operation for im House for Umuahia, Abia State for southeast Nigeria.
For June 2021, security pipo for Kenya arrest Kanu and carry am by force come back to Nigeria to face trial.
Di initial charges against di Ipob leader bin dey 15, but Justice Nyako bring am down to seven.
Even though di Court of Appeal later strike out all di charges and discharge Kanu, di Supreme Court reinstate di seven charges as dem tok say di Ipob leader get questions to ansa.
Im dey face treason and terrorism charges and dem later transfer di case to anoda Judge, Justice James Omotosho for di same Abuja.
For September, di Federal High Court, Abuja overrule di no-case submission wey Nnamdi Kanu file against di terrorism charges wey Nigeria govment sama am.
Justice James Omotosho wey dey in charge of di trial rule say govment don establish prima facie evidence against Kanu and in di spirit of fair hearing, di defendant dey required to enta im defence.
Di court bin also order make di Nigeria Medical Association (NMA) investigate Kanu health status to determine weda e dey fit to stand trial and weda e dey necessary to transfer am from di detention facility of di Department of State Services (DSS) to di National Hospital.
Afta a few days, di Court Abuja deny di application to transfer Nnamdi Kanu, leader of di Indigenous People of Biafra (IPOB) to di National Hospital.
Justice James Omotosho give di ruling based on di report by di Nigeria Medical Association (NMA) wey tok say Kanu dey fit enough to stand trial.
According to di report, di NMA say dia evaluation show say di health conditions wey Kanu get no dey life threatening and di medical facility for di premises of di Department of State Services, DSS, dey equipped enough to treat am.










