Health benefits of green pepper

Wia dis foto come from, Yasuhiroamano via Getty Images
- Author, Abubakar Maccido
- Role, Reporter
- Reporting from, Kano
- Read am in 3 mins
Green pepper wey pipo dey also call bell pepper na one kain vegetable wey belong to di same family wit chili pepper, tomato and eggplant.
E first come from Central and South American kontris like Mexico, Peru and Bolivia. Pipo for dat side don dey plant am for more dan 6,000 years both for food and for medicine.
If you dey chop green pepper steady, e fit make your bodi strong, help you recova quick from sickness, and protect you from common infection like cold and flu.
One Dietitian Ibrahim Abdulsalam Bichi for Kano tok say "Green pepper get almost two times more Vitamin C pass orange (per 100g wen e fresh), and dat one make am strong food wey fit boost pesin health well well."
E still tok say if pesin dey chop green pepper regularly, e go help di body stay healthy for long.
Health benefits of green pepper
- Rich in Vitamin C: Green pepper full wit Vitamin C wey dey help di bodi fight disease and keep skin fresh and fine.
- E get strong antioxidants: Green pepper get natural chemical wey dem dey call antioxidants - e dey protect bodi from damage and slow down old age and sickness.
- E good for eye: Green pepper dey help pesin see well, especially for night, and e dey protect eye from damage and old age wahala.
- E dey help for weight control: Bicos green pepper get small calories, e fit help pesin lose weight or maintain healthy body size, and e still fit make belle full quick.
- E good for heart: Green pepper dey keep heart healthy and reduce chance of heart disease.
- E dey improve vision: Green pepper dey support beta vision and protect eye from disease and damage.
- E dey boost immune system: Green pepper dey help bodi fight infection and sickness by making immune system strong.
Nutritional value of green pepper (Per 100g)
Calories: -20 kcal
Water content: -92%
Protein: -0.9 g
Fat: -0.2 g
Carbohydrates: -4.6 g
Vitamin C: -80-120 mg
Side effects of green pepper
- Allergic reaction: Some pipo fit get allergy to food wey belong to nightshade family (green pepper dey inside dat family).
- Digestive wahala: If pesin chop am raw too much, e fit cause bloating, gas or stomach pain.
- Heartburn (acid reflux): Green pepper get small acid - e fit cause heartburn for some pipo.
- Medicine Interaction (rare): Hot pepper wey get capsaicin fit affect how some medicine dey work, but green pepper no too get capsaicin, so e no dey common.
Generally, dis kain side effects no dey happun often, and even wen e happun, e small.
Green pepper na veri nutritious and safe food for most pipo if dem dey eat am as part of balanced diet.










