Over 10 years of mass kidnappings for Nigeria: Why govment no fit stop am?

One pair of shoes for inside student dormitory for St Mary's Catholic School for Niger state afta one mass kidnapping. Bunk beds dey visible wit some personal belongings scattered across di room.

Wia dis foto come from, Ifeanyi Immanuel Bakwenye / AFP via Getty Images

Read am in 5 mins

Nigeria still dey shake from one of di worst mass abductions di kontri don see.

Gunmen kidnap more dan 300 children and staff from one Catholic school - St Mary's Private Primary and Secondary School for Niger state on Friday, 21 November, although President Tinubu confam say some of dem escape and don reunite wit dia parents.

Dis na di third time dis kain attack go hapun for di kontri inside one week.

Di kidnapping of pipo for ransom by criminal gangs, wey dey known locally as bandits, don become major problem for many parts of Nigeria.

E don pass more dan 10 years since di militant Islamist group Boko Haram take 276 girls from dia school for di town of Chibok for Borno state, north-east Nigeria for 2014.

Di incident catch international attention and e spark one global campaign wey ginger for dia return.

Many from Chibok don either escape or gain freedom - but up to 100 still dey miss.

So why kidnappings still dey happun?

Remote schools

Relatives and students carry luggage - one woman for di centre of di foto carry one big box on her head

Wia dis foto come from, John Okunyomih/ AFP via Getty Images

Most part of northern Nigeria dey face chronic insecurity. Di parts wey dey affected di most na di northwest and northcentral, as armed groups dey operate for di remote areas.

Here di modus operandi of di kidnappings dey follow one similar pattern - armed gangs on motorcycles go land one area, begin shoot to fear pipo, kidnap victims and go den quickly vanish into nearby forests.

Experts believe say dis attacks by so-called bandits dey financially rather dan religiously motivated, plus say dem dey target schools in particular bicos dem believe say most of dem get relatively weak security.

Analysts also say kidnappers believe say parents go likely pay ransoms to see di return of dia children.

Meanwhile for di north-east, no be only financial gains dey motivate extremist groups like Boko Haram, but dem also dey driven by one militant form of Islam, dia rejection of Western education and dia belief say girls no suppose dey educated.

Dia campaign of terror don last more dan one decade and e don result in mass displacement and many deaths, according to di UN.

Experts also say insecurity don also deteriorate sake of di way weapons don enta Nigeria since di fall of Muammar Gaddafi for Libya ova one decade ago, di mata also dey worse sake of Nigeria porous borders.

No ransoms and no education

Women and men gada to mark one decade since di kidnapping of 276 girls from Chibok, many of wey still dey miss.

Wia dis foto come from, Adam Abu-bashal/Anadolu via Getty Images

Govment don ban di payment of ransoms as part of effort to cut di supply of money to di criminal gangs - but e get little effect.

Nigerian President Bola Tinubu bin postpone im foreign trips in order to address di security concerns.

Some state govments especially for di northern part of di kontri don shutdown schools for di state sake of di kidnappings palava.

But di rising insecurity dey ginger anger plus fear for Nigeria, as citizens dey demand stronger action to protect children and communities.

Di Nigerian army dey try face di abductions across di north, particularly for di north-east, but dia resources dey seriously stretched.

For di northwest, di govment dey also rely on traditional leaders to try do deals wit di bandit gangs to return di kidnapped children.

Na di economy

A close-up of one street hawker for Nigeria wey dey sell different bags.

Wia dis foto come from, Pius Utomi Ekpei/AFP via Getty Images

Some analysts don tok say direct correlation dey between di state of Nigeria economy, di poor infrastructure and di rise of insecurity - particularly for di north.

For instance, constant unreliable electricity supply dey affect opportunity, innovation and job creation.

One recent editorial for Nigeria BusinessDay newspaper say Nigeria lack of employment opportunities "dey feed dis recruitment pipeline".

"Kidnapping don become, for many marginalized youths, di only visible pathway to wealth. Wen crime become aspirational, di state don already lose strategic ground."

Di Africa-focused SBM Intelligence consultancy tok say wetin dey needed na "advanced tracing technologies" to scata di kidnappers financial networks but make stabilising di economy dey prioritised urgently to "undercut criminal recruitment".

Trump on Nigeria

Friday mass abduction dey come afta right-wing figures for US, including President Donald Trump, say Christians dey face persecutions for Nigeria – accuse wey di Nigerian govment don dismiss.

For months, campaigners and politicians for Washington don allege say Islamist militants dey systematically target Christians for Nigeria.

Earlier dis month, Trump say im go send troops enta Nigeria "guns a-blazing" if di African nation govment "continue to allow di killing of Christians".

Di Nigerian authorities don call di claims say Christians dey face persecution as "gross misrepresentation of reality".

One official tok say "terrorists dey attack all di pipo wey reject dia murderous ideology - Muslims, Christians and dos of no faith alike".

For di north-east, jihadist groups don dey battle for di state for more dan one decade.

Organisations wey dey monitor violence say most of di victims dia na Muslim bicos most of di attacks hapun for di north wia majority of dem be Muslim.

For di centre of Nigeria, frequent deadly attacks between herders also dey occur – most of di herders na Muslim - for farms wey be say na Christians get most of dem.

However, analysts say dis clashes often dey motivated by competition for resources, like water or land, rather dan religion.

Reporting by BBC News, BBC News Africa and BBC Global Journalism