Improve heart health, regulate blood sugar and oda health benefits of onion

Onions

Wia dis foto come from, John Harper via Getty Images

    • Author, Abubakar Maccido
    • Role, Reporter
    • Reporting from, Kano
  • Read am in 2 mins

Onion wey dem also sabi as Allium cepa na bulb vegetable wey pipo dey use for cooking becos e get strong flavor and aroma. E belong to di Amaryllidaceae family, and e fit be red, white or yellow.

You fit chop am raw, fry am small, roast am, or add am inside soup and stew.

"Di natural sulphur wey dey inside onion dey fight bacteria and reduce inflammation," dietitian Aisha Bala Ahmad tell BBC News Pidgin.

She also tok say pipo wey dey chop onion steady don show lower risk of some kain cancer sake of di antioxidants wey e get.

Six health benefits of onion

  • E dey boost body immunity: Vitamin C dey help make bodi strong to fight infection.
  • E dey improve heart health: Onion get flavonoids like quercetin wey dey help reduce cholesterol and blood pressure.
  • E fit help regulate blood sugar: Compounds like allyl propyl disulfide fit help bring down high blood sugar levels.
  • E get anti-inflammatory and antibacterial power: Di natural sulphur wey dey inside onion dey fight bacteria and reduce inflammation.
  • E dey support digestion: Onion get fibre and prebiotics wey dey feed di good bacteria wey dey your belle.
  • E fit help prevent cancer: Pipo wey dey chop onion steady don show lower risk of some kain cancer becos of di antioxidants wey e get.

Nutritional content (for evri 100g raw onion)

  • Calories: 40 kcal
  • Protein: 1.1 g
  • Carbohydrate: 9.3 g
  • Dietary Fibre: 1.7 g
  • Fat: 0.1 g
  • Vitamin C: 7.4 mg (12% of daily value)
  • Vitamin B6: 0.12 mg
  • Folate: 19 µg
  • Potassium: 146 mg
  • Calcium: 23 mg
  • Magnesium: 10 mg
  • Phosphorus: 29 mg

Special dietary advice: Dietitian Ahmad advise say if pesin wan chop onion raw, some pipo fit get heartburn or gas afta dem eat am. To avoid dat kain wahala, pesin fit cook am small to make am soft for di stomach.