President Trump to get di first Fifa Peace Prize Award as di World Cup draw go hold today - dis na how e go work

Di Fifa World Cup trophy outside di White House

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Washington DC for USA na di city wia di World Cup draw go happun even though di city no go host any matches
    • Author, Dale Johnson
    • Role, Football issues correspondent
  • Read am in 8 mins

Di 2026 World Cup finals go happun for Washington DC for di United States of America dis Friday but e no go be straightforward process like dat, so plenti dey to explain and we go break am down simply make you for understand.

Di ceremony go start by 17:00 GMT wey be 6PM Nigeria time and na Supermodel Heidi Klum, comedian Kevin Hart and actor Danny Ramirez go be di co-host.

Bifor di draw, live music performance go dey from Andrea Bocelli, Robbie Williams and Nicole Scherzinger, while Fifa president Gianni Infantino and US President Donald Trump go also make speeches.

Former Manchester United and England defender Rio Ferdinand go conduct di draw, togeda wit broadcaster Samantha Johnson and oda sporting giants like Tom Brady, Wayne Gretzky, Aaron Judge and Shaquille O'Neal.

Di entire ceremony suppose last about 90 minutes, and dis article go explain how e go work, wetin to expect and tins to look out for.

Anoda ogbonge part of di event na di presentation of di first eva Fifa Peace Price, wey go dey awarded to di US President Donald Trump.

Wetin we call dis Video, BBC Sports Editor Dan Roan report from Washington bifor di 2026 World Cup draw

Wetin be di Fifa Peace Prize?

Donald Trump and Gianni Infantino pose for foto as dem give di camera thumbs up.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Trump go receive di first eva Fifa Peace Prize

Fifa bin introduce di 'Peace Prize' to recognise individuals wey dia actions bring peace and unity.

Going forward, dem go dey award di prize evri year to di pesin wey don "take exceptional and extraordinary actions for peace" and "wey don unite pipo across di world".

"For dis world wey dey get increasingly unsettled and divided, e dey important to recognise di outstanding contribution of pipo wey dey work hard to end conflicts and bring pipo togeda in spirit of peace," Fifa President Gianni Infantino bin tok for one statement.

E add say football "stand for peace" and say di di award go "recognise di enormous efforts of individuals wey dey unite pipo, bringing hope for future generations".

One oda senior oga for Fifa even tell BBC Sport say dis Fifa Peace Prize fit become di most important peace prize for di future.

"Why dis no fit dey bigger dan di Nobel Peace Prize? Football get ogbonge global support, so e dey right say e dey recognise extraordinary efforts to bring about peace evri year."

How di seeding process go be?

Balls wey contain di names of di 48 teams wey go take part for di 2026 World Cup go dey inside four pots, 12 teams for inside one pot according to di Fifa world rankings.

Di only exceptions na di three hosts kontris - USA, Mexico and Canada - wey go automatically dey pot one, and di teams wey go qualify through di six play-offs; dem go dey for pot four.

Di six play-off paths na:

Uefa Play-off A: Italy, Wales, Bosnia-Herzegovina, Northern Ireland

Uefa Play-off B: Ukraine, Poland, Albania, Sweden

Uefa Play-off C: Turkey, Slovakia, Kosovo, Romania

Uefa Play-off D: Denmark, Czech Republic, Republic of Ireland, North Macedonia

Fifa Play-off 1: DR Congo, Jamaica, New Caledonia

Fifa Play-off 2: Iraq, Bolivia, Suriname

How di draw go work?

Di 12 groups go include one team from each of di four pots. Fifa go start by picking di teams from pot one.

Co-hosts Mexico (A1), Canada (B1) and di United States (D1) go get balls wey dey for dia flag colour to show dia special status. Di group positions don already dey pre-determined to make sure say dem go play all dia group games for dia own kontris.

Den di draw go continue wit pots two, three and four for dat order.

Why Fifa go keep di top four teams apart?

Di big idea be say Fifa wan set up di best chance of ogbonge matches for di latter stages of di World Cup.

So for di first time, dem go give special seeding status to di top four teams for di world rankings wey be Spain, Argentina, France and England.

However, dis status go only apply if di kontris win dia groups. Make we use England give example:

Each of di four kontris go dey drawn into group for different colour quadrant of di bracket, as e dey for di image below.

Spain (ranked 1) and Argentina (2) must dey for di opposite halves and dem no fit meet until di final, likewise France (3) and England (4).

France and England also no fit meet either Spain or Argentina until di semi-finals.

Assuming say France come out first and go into Group C, e go place dem into di green quadrant for di right side of di draw. Dis mean say England fit only go into di blue or turquoise quadrants for di left side, groups E, F, G, H or I.

If Argentina den drop into di blue quadrant, e further restrict England only to turquoise - groups G or H.

But e mean say di four teams wey dey seeded don get easy ride? No be like dat.

Each quadrant get potential last-16 tie between two group winners. For instance, di blue quadrant go see meeting of di winners of Group E and Group I.

E mean say di team wey dey seeded fit meet anoda pot one side, perhaps Brazil.

Teams wey dem draw into groups C, F, H or J be like say dem dey more favourable, becos e no dey possible to play anoda group winner until di quarter-finals.

If any one of di four seeded teams finish second for dia group, den dem go lose di ranking privilege.

For example, if England finish second for Group H, dem go move out of turquoise and go into red wia dem fit meet Spain, Argentina or France as di winners of Group J for di first knockout round.

Di World Cup knockout bracket showing di four different quadrants for di seeded teams

Wia dis foto come from, Fifa

Wetin we call dis foto, If Spain, Argentina, France and England win dia groups dem go enta into separate quadrants for di knockout bracket

Wetin be di restrictions to watch out for?

More dan one team from di same confederation no fit dey for one group. For example, Brazil and Uruguay (Conmebol) no fit dey for di same group, or Panama and di United States (Concacaf).

But exception dey for Uefa becos dem get 16 teams and na only 12 groups dey. Dis mean say four groups go get two European kontris.

Dis process look straightforward, but as we go on dis constraints go cause serious complications as kontris skip groups to avoid clashes wit teams from dia own confederation.

Dis mean say e no go just be case of teams slotting into Group A, and den Group B, and den Group C in order as di draw go.

Wen we get to pots three and four, e fit appear like say kontris dey go into random groups.

Fifa gatz prevent somtin called deadlocking, and dis fit happun wen e no longer dey possible to complete di draw following di regulations.

Di major issue na from di teams wey fit qualify through di inter-confederation play-off pathways and go into pot four.

Pathway 1 get New Caledonia (OFC), Jamaica (Concacaf) and DR Congo (CAF)

Pathway 2 get Bolivia (Conmebol), Suriname (Concacaf) and Iraq (AFC)

Both pathways get Concacaf team, so dem dey automatically blocked out of four groups (di ones containing di United States, Mexico, Canada and Panama).

Di first pathway na less of problem, becos di only oda Oceania team, New Zealand, also dey for pot four.

But di second pathway dey complicated, becos e get 17 deadlocking nations for pots one, two and three. So, di only way to complete di draw na for di team wey qualify through dis route to go into group wey get two European kontris and one African nation.

How teams go dey allocated to dia groups?

Once dem don draw any team, dem go enta di first available group, keeping to di draw constraints, in alphabetical order.

Di draw computer go make sure say Spain, Argentina, France and England dey placed for groups inside di correct quadrant of di bracket.

To speed up di process kontris no go dey drawn into dia specific group positions to set di order of di fixtures.

Seeded kontris go all go into position one, wit pre-determined grid for all di oda pots, as di image below show.

For instance, make we take Scotland for pot three. Dia fixture order go dey determined by di yellow box.

If dem dey drawn first from pot three dem go go into Group A wit Mexico.

Di grid show say di team from pot three go go into position two.

Di first match na A1 v A2, so Mexico go play Scotland for di opening game of di World Cup.

Di distribution of teams by pot for di World Cup draw

Wia dis foto come from, Fifa

Wetin we call dis foto, Di group position by pot don dey pre-determined and e no go dey decided by draw

Wen teams go find out wen and wia dem go play?

Kontris go know dia opponents and match dates dis Friday, 5 December, but dem gatz wait for 24 hours to find out dia venues and kick-off times.

Di exceptions na groups A (Mexico), B (Canada) and D (US), wey contain di three host kontris and dem don already get venues for di fixtures, but not kick-off times.

For all di oda groups, dem go know only di date and di order of matches wen Fifa unveil di match schedule for live broadcast on Saturday, 6 December at 17:00 GMT (6PM Nigeria time).

Some legends of di game go join di Fifa president Gianni Infantino to discuss di ogbonge matches.

All 12 groups go play dia matches for dis order:

Match Day 1: 1 v 2, 3 v 4

Match Day 2: 1 v 3, 4 v 2

Match Day 3: 4 v 1, 2 v 3