Police reveal charges against Regina Daniel brother, why dem arrest Sammy West

Foto of Regina Daniel and her broda Sammy West.

Wia dis foto come from, regina.daniels/Instagram

Read am in 5 mins

Di police don finally release informate on wetin dey happun to Nigerian actress Regina Daniels brother.

Federal Capital Teritory, police command for Abuja say Samuel Ojeogwu wey pipo sabi as Sammy West dey dia custody.

Di command say dem receive one petition against di actress brother for alledged conspiracy, trespass, assault, criminal intimidation, theft and cyber-bullying.

FCT police tok-tok pesin, SP Josephine Adeh, tok say dem bin don invite Sammy for questioning but e no gree show.

Dis na wetin carry dem go Lagos "on di authority of di duly issue arrest warrant from di competent court, and den carry to Abuja for more investigation," to arrest am.

No be tori again say Regina Daniels get kwanta wit her husband Senator Ned Nwoko, a Nigerian politician.

Di couple don come out social media to respond to allegations but di cause of dia kwanta neva really clear.

Di Nollywood actress post one video on Instagram on Friday morning wia she dey cry ova di detention of her brother, Sammy West by di Nigeria Police Force (NPF).

Regina demand answers to why police neva gree to release her broda from dia custody.

"I try, I feel say I dey go crazy and I dey lose my mind, and E no make any sense. I dey cry presently in front of everybody. Please, wetin I dey beg for? I no know," she tok.

"Una tink say e dey easy to dey wake up and seeing one tin about my broda online? Today, I go hear some good news say dem go release am, and tomorrow, I go hear anoda tin. Like, wedtin be di problem? I don try, but I go, go back."

Di police tok-tok pesin tok say dem don charge Sammy West to court on 6 November on charges "bordering on criminal conspiracy, criminal trespass, assault, criminal intimidation, and theft."

She tok di court don remand am pending di fulfilment of im bail conditions.

BBC Pidgin bin report say Regina and her husband husband, Ned Nwoko, di senator representing Delta North, dey face marital issues.

Regina bin claim say she dey face domestic violence for her own marriage while her husband Oga Nwoko say na becos im want make im wife see experts ova her struggle wit drug abuse.

Di couple get two children togada afta dia traditional marriage in 2019.

Wetin be my broda offense ? - Regina Daniels ask

Screengrab of Regina Daniels post for instagram

Wia dis foto come from, regina.daniels/Instagram

On her Instagram page, Regina tok say becos her broda dey fight for im sista Nigeria police force hold am for dia custody

"I give up ! Wetin be my broda offense? Fighting for im baby sista becos im in-laws go always beat her up? I give di Nigerian police some respect, but shame on you all! Di highest bidder dey always win. Now I dey crippled!" She tok.

"I go return if dat na di only way, do wetin (Ned Nwoko) tok, get inject to be like zombie, get lock up and rape in di house. Only den my broda go return. Becos by law, no tangible case against Sammy West! Ned Nwoko dey bigger dan di whole of Nigeria; dat na wetin dis means. We don lose, or rather, I don lose."

Regina also alleged say Oga Nwoko dey try arrest her mama, Rita Daniels, as dem di police don invite her too.

"Ned don issue arrest warrant against me. Dem go arrest me on or bifor Monday," she write, as she share di screenshots of her conversation wit her mama.

Oga neva comment on dis allegations by im wife, Regina and her family.

Regina Daniels profile

Foto of Regina Daniels

Regina Daniels na popular acctress for di Nollywood industry.

Regina start her career as child actress at di age of 7. She feature in her first movie for 2007 in di movie "Marriage in Sorrow".

Since den she don feature in ova 100 Nigerian movies including Miracle Child, Python Girl, Spider-Girl, Hanging Coffin, Jaja the Great, Queen Rebecca, among odas.

Regina Daniels marry Ned Nwoko at di age of 18. Dia marriage don reach six years and dem both get two pikin.

Regina na di youngest wife of Ned, and she dey popular as an actress in di Nigeria feem industry. Dem don nominate her for plenti awards and she don win some too.

Regina get five siblings, wey dey supportive of her career and she be Mass Communication graduate and recently she join di Senators Wives Association as dia social secretary.

Ned Nwoko profile

Sixty-four-year-old, Ned Nwoko na Nigerian politician, lawyer and philanthropist.

Ned Nwoko go University of Keele, Staffordshire, wia e bin get im first and second degree in law.

Afta e finish school for UK, dem call am to English Bar for Lincoln Inn, one of di four Inns of Court for London.

Ned Nwoko start im career as lawyer for United Kingdom, wia e gada experience bifor e come back Naija to do politics and business.

For 1995, dem recognise am as di Best Black Lawyer of African Descent for England, for im success in di England legal field.

After e make am well for im legal career for United Kingdom, Nwoko return back to Nigeria for 1998.

E enta politics for 1999 and serve as House of Representatives member, e represent Aniocha/Oshimili Federal Constituency of Delta State from (1999–2003)

Ned na still active politician and e be sitting senator wey dey represent Delta North Senatorial District.