BBC News, Pidgin - Home
Top Tori
Gunmen reportedly kill ova 100 pipo for Kwara state
Di attack wey occur late Tuesday for Woro and Nuku communities dey come afta di military recently carry out operations for di area against wetin dem call "terrorist elements".
'Painful times for my marriage' - Melinda French Gates react to ex-husband in Epstein files
She say her ex-husband and odas dem name inside di Epstein files need to ansa whatever kwesions wey remain.
Wetin we know about US 'small team' of troops wey dey Nigeria
Dis development na follow up from di airstrikes wey di US military bin carry out for Sokoto State on Christmas Day of 2025.
Wetin be di next tin for leader of South Africa second largest party wey comot from DA leadership?
John Steenhuisen take ova di leadership of di Democratic Alliance (DA) for 2019 as Federal Leader and e currently dey serve as agriculture minister for President Cyril Ramaphosa govment.
Saif al-Islam, Muammar Gaddafi son die after one 'four man commando' unit shoot am according to reports
Di 53-year-old, wey bin once widely dey seen as di second most powerful person for Libya die after dem shoot am on Tuesday according to Libyan media.
Popular Ghana Prophet ElBernard say e go 'stop' public preaching afta im give prophecy wey fail
Prophet ElBernard bin prophesy say one candidate Kennedy Agyapong go win di opposition new patriotic party (NPP) presidential primaries.
All di charges against ex-AGF Malami as court remand am, son for DSS custody ova alleged terrorism financing, arms possession
Dis new gbege dey separate from di 16-count of moni laundering charges wey di EFCC bin don sama di former Justice Minister.
79 Nigerians, 18 Ghanaians wey dey on US criminal list dey face deportation
For di list wey US Homeland Security bin publish on dia website on Monday, 2 February, Immigration and Customs Enforcement (ICE) arrest more dan 1,000 pipo ova di weekend on top deadly crimes
Why former US President Bill Clinton and im wife dey testify for late sex offender Jeffrey Epstein mata
Di couple later gree follow di House Oversight Committee demands afta dem argue for months say di subpoenas no valid.
Ginger Me
Special Tori
'Wetin Senate do no be Electoral reforms, na betrayal of public trust' – Yiaga react to di electoral amendement
Inec chairman Joash Amupitan bin dey concerned say di amendment of di Electoral Act get plenti delays.
Seven million cancers yearly dey preventable as report list contributors to more dan 18 million cancer cases
Scientists tok say powerful opportunity dey to save lives becos nearly 40% of cancers dey preventable.
Saudi Arabia launch passport for camels
Saudi Arabia vice minister of environment, water and agriculture, Mansour Almushaiti on Tuesday announce say di kontri don launch di "Camel Passport"
Gospel legend Ron Kenoly die at 81
Im music director Bruno Miranda confam im death on top di singer official Instagram account.
'Why I ask my husband for open marriage afta ten years'
Sexologist Ilana Eleá say to open up marriage dey natural and worth embracing, but warn say no be solution for broken relationships.
Trump threaten to sue Trevor Noah on top Epstein joke for Grammys
Di US president bin label Noah as a "total loser" on top one joke e tok on stage during di awards ceremony.
Four important questions to ask yoursef bifor you enta friendship wit your ex
Dis na di four questions wey you suppose ask yoursef bifor you decide weda to remain friends wit your ex or cut off contact completely.
BBC News Pidgin now dey on Whatsapp
No dull yoursef, be di first to get latest tori, analysis, exclusive interviews and ogbonge coverage of Nigerian and International news from BBC News Pidgin, straight to your Whatsapp.














































