David Mark
David Alechenu Bonaventure Mark GCON (wey dem bon for 8 April 1948) na retired solja for Naija army wey don rish Brigadier General bifor e kom turn politishan. E sarf as di 12th President of di Nigerian Senate fom 2007 rish 2015, and e be Senator for Benue South senatorial district fom 1999 rish 2019.
As of nau, e be temporari National Chairman for one politika parti wey dem dey kol African Democratic Congress (ADC). E join ADC afta e komot fom PDP for 2025.
Bifor e enta politis as senator, David Mark don sarf as militiri govnor for Niger State fom 1984 to 1986, and one taim, dem apoint am as Minista of Communikeshon. Insaid ol di pipul wey bi Senate President for Nigeria, na David Mark sarf for plenti years pas.
Life and di skul wey e go
[chenj-am | chenj-am for orijin]David Mark na Otukpo pesin for Benue State, and dem bon am for April 1948. E first go St. Francis Catholic Practicing Skul, leta e go Nigerian Military Skul and afta dat, Nigerian Defence Academy. For 1970, dem mek am Sekond Lieutenant (Wey bi first offisa rank for solja), and by 1971, e don be Captain. For 1974, e be Commandant for Static Kommunikeshon. For 1976, dem giv am politika wok as Chairman for committee wey dey tek kia of properties Wey dem liv for di Eastern region of Nigeria.
How e wok as Minista
[chenj-am | chenj-am for orijin]David Mark be Minister of Kommunikeshon, and e dey in charj of NITEL (Nigerian Telecommunications Limited) and NIPOST (Nigerian Postal Service). As minista, pipul sabi sey e no dey hide wetin dey e maind.
One taim for 1989, wen e go inspect dia ofis for Akure, som union workas komplain sey som of dem neva get promoshon sins 1978. David Mark tel dem sey enibodi wey no get promoshon sins dat taim fit nid to retire or komot fom wok.
E stil tok sey pipul wey dey tiff telephone wire mek dem kil dem by lor. E tok sey govment nid to remuv telecom tins wey nobodi dey uze, bikos dem jos put di tins for politika reasons, no be bikos pipul rili nid phone network for dat aria.